Translate

Thursday, 6 October 2016

CRAZY AJEKPAKO INSULTS


CRAZY CHILDHOOD INSULTS ONLY A NIGERIAN AJEkpAKO WILL RELATE WITH


·        1. You mess harmattan catch eba. “ seriously”

·        2.2 kuli kuli attack your village, nobody escape. “ baddosneh”

·        3.You mess akpu fly gate. “under which level nah”

·        4. You mess five akara form voltron. “ blood of Zachariah “

·        5. The finest girl for una village nah monkey they toast am. “ she must be really fine in an ironic way”

·        6. You mess Babaginda repeat primary 1. “ watin the man do u”

·        7. The strongest man for una village nah eba kill am. “ wha…….”

·        8. The tallest man for una village dey use ladder climb maggi. “ watin him dey do with maggi”

·        9.The richest man for your village dey use shovel drink garri. “ watin concern me”

·        10.Your scatter scatter teeth like Rambo bullet. “ chai…..  diz 1 dey pain wel wel”

·        11.You shit here, shit here dey find the 1 the one wey resemble you. “maka why nah”

·        12.You bombastic element. “I still no know the meaning of that”

·        13.Tear tear patch patch, omo baba shoe maker. “ wen u hear this song trust me somtin dey wrong with ur shorts”

·        14.Your head like hallelujah band. “ watin dat 1 mean”

·        15.You jump from 30stori building notin do u, nah only ur pant slack. “ hehehe”

·        16.U chop okro go backyard dey draw. “lolzzzzzz”

·        17.U chop akara vomit ororo. “ ok……!!!!!”

·        18. Ur mama say make u check time u say long prick dey pursue ashawo. “ nigga u dead”

·        17. U mess, e no do pamm, e no do poo…. E do chai ngozi. ‘ wen ynash start to talk”

·        18. U carry ur pant go river 9ja all the fish die. “ lol diz 1n dey pain girls”

·        19. U mess akara wear eye glass. “ hmmmm…. I hear”

·        20. U drink gulder finish enter d bottle dey find ultimate. “ hahahahahahahahahahahah”

 
Kililinda I no dey do again.
Hahahahahahahahaha…… plz do share yours.

1 comment: